[English] Hemenakiz - Steady Ambition
by Hemenakiz
Spoken Word Hip-Hop + Naija Rap
Opening Swifin Music…
Lyrics
By hemenakiz [Intro] Street no be by force… Na by vision… [Rap] I never rush your street come throw banger, I no dey form say I be hash ranger, Lowkey vibes but the flow dey danger, Mind steady, I dey plan like manager. All the guys know say the boy too cool, No loud mouth, I dey play my rule, Dem dey find gist but I dey build tool, Future bright, my mindset school. Never try to find my hash mission, Deep coded like high you know I have mission, Every calm because I need passion, Me I just come to help and bust talent because you know I really need build my own nation, From the ground up, solid foundation, No be hype, Oh! na dedication, All my Dream big pass that's imagination. [Hook] You go never know ‘cause I get vision, Silent grind, steady ambition, No competition, na my position, hemenakiz on a new dimension. You go never see the full picture, Till the blessings come set for you to see bigger, From the street to the main function, I dey rise like strong scripture. [Verse 2] I no dey envy your small paper, My time dey come sooner or later, Plant my seed like true creator, Water am well, now e dey greater. No distraction, I lock my focus, Dem dey doubt but I know my locus, Every step sharp like hocus pocus, But na hard work be the real bonus. I no rush fame, I dey build name, When e burst out, e go be flame, Different level, different game, hemenakiz no dey chase cheap fame. [Bridge – slow flow] Vision clear like early morning, Even when the sky dey storming, I keep moving, no dull forming, Glory dey ahead, what's up my friend I'm still coming. (Outro) From the street but my mind global, Every hustle turning to noble, If you sabi me, you know say I stable, No be by noise, na by cable. Remember the name when the name hemenakiz in the big city…🎶